Saturday, May 30, 2009

Dialogue!


Somewhere in the Niger Delta amidst the staccato(ol boy i dey speak English sha!) of machine gunfire and the booming of warships lay two young men(who we shall refer to as militants from now) taking cover in the bush,
Militant 1:Black scorpion,which one be all dis na?dem no tell us say we go fight na.dem say we go just dey thief oil.once in a while we go wear mask,carry gun,dey dance for boat and dem go film us.Nobody talk say we go dey dodge all these aboki soldier bullet.All these soldiers sef!no be their fault sha,na condition cause am,dem no even get manner of approach!
Militant 2:Viper,why we dey hide for bush,make we go fight.
Militant 1:my friend,sit down there!
LOUD EXPLOSION!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!
Militants in unison:YE!!!!!!!!!!!!!!
Militant 1:black scorpion,wait now,no leave me for here.
Militant 2:Guy,who be black scorpion?My name na Ejiro.ol'boy me i don kawa,we go dey see for Warri!

Na to go buy canoe oh!


Ol'boy,the global meltdown no just dey favour niggas at all.From London to Tokyo,California to Isale-eko,in fact,from Sydney to Effurun junction for Warri,the thing dey melt die.All my guys for cafe dey hear am no be small.In fact one guy tell me say he just send im maga small thing based on say owu don almost kill the guy for yankee!But we for naija know say no be today economy melt down,our own don melt tey tey,the water don almost carry us go.
What could have sent the economy a-tumbling?Is it the crazy western lifestyle of buying everything on credit;houses,cars,clothes.sex..............i hear say working girls for that side dey collect credit card these days.Abeg no talk am outside oh!You go tell me who tell you!
You cannot sustain the world economy on a culture of credit and deceit for so long,sooner or later the repercussion was bound to be felt.Unfortunately it was not restricted to more affluent climes,the meltdown's dripping wetness was bound to rain on the poor in parts of the world where credit is a foreign word.Remember say for naija na ''no credit today,come tomorrow'' dem take raise us!
Gone are the days of economic buoyancy when all we do is go to the tailor's and cut materials for Aso-ebi,the only cuts been done these days are the bad types;wage cut,job cut,budget cut!
P.S:this is the time to pick that outstanding talent of yours and develop it cos you never can tell,the melt down could be around the corner at your work place,and i don't wanna see you get wet!