Saturday, May 30, 2009

Dialogue!


Somewhere in the Niger Delta amidst the staccato(ol boy i dey speak English sha!) of machine gunfire and the booming of warships lay two young men(who we shall refer to as militants from now) taking cover in the bush,
Militant 1:Black scorpion,which one be all dis na?dem no tell us say we go fight na.dem say we go just dey thief oil.once in a while we go wear mask,carry gun,dey dance for boat and dem go film us.Nobody talk say we go dey dodge all these aboki soldier bullet.All these soldiers sef!no be their fault sha,na condition cause am,dem no even get manner of approach!
Militant 2:Viper,why we dey hide for bush,make we go fight.
Militant 1:my friend,sit down there!
LOUD EXPLOSION!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!
Militants in unison:YE!!!!!!!!!!!!!!
Militant 1:black scorpion,wait now,no leave me for here.
Militant 2:Guy,who be black scorpion?My name na Ejiro.ol'boy me i don kawa,we go dey see for Warri!

No comments: