Saturday, March 21, 2009

Na for only warri!(your pidgin as to be passable to understand this one)

Na for only Warri where you go see two guys dey kpouns security guard for bank.When you ask them say wetin happen?One of them go talk say 'oh bobs,i no know,i just dey pass when i see this security dey beat my bros,no be say i wan fight cos as you see me so i no like wahala.i just say make i branch apply bottle for the guy head but as I apply the first one,gbim,
the guy no fall,i apply the second one,gboa,nothing happen,i come shook am,shook am everywhere,the guy no still gree,na that time i talk say i kuku wan fight!'
Na for only Warri where if person wan give you direction,the gist goes thus,'when you reach the next turning,the third house very close to Akpos mama house,you suppose know Akpos now?Akpos wey dey do oil bunkering!Okay!!!!!!!!!!!black Akpos?Uhn Uhn,no be black Akpos wey dey thief,dat one house still dey down the street!
N a for only Warri you go chop the sweetest peppered kpomo with cold beer,meet guys who can speak pidgin at a million words per minute,and laugh till your heart stops beating.
Na for only Warri!
P.S:this goes to the guys who took me to Warri for the first time in my life,Oniovu Bekibele One a.k.a Oghenepuffy,Omilinkus a.k.a Papi and the only Indian man to come from from Delta State,Abel a.k.a Acha Nehi Baba.
Hope you guys are doing well.Big ups!!!!!

No comments: